Canada uncover case of bribery to approve study permit, ova 60 oda misconducts within dia immigration system
Di Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC) say dem don uncover series of misconduct cases within dia department, wey include employee wey dey solicit bribes to approve study permits for Canada.
IRCC bin release one misconduct report wey dem say go help dem achieve transparency and to put eye for di integrity of Canada immigration system.
Di report find say some employees dey breach privacy by accessing sensitive files and di act dey against di code of conduct of Canada immigration department.
According to di report, dem find 62 cases of misconduct out of 76 investigations and e include harassment and violations of IRCC Code of Conduct.
Di IRCC na department wey dey responsible for processing millions of immigration applications annually, wit ova 11,000 employees.
Also dis report wey cover from 2023 – 2024 dey affect department wey dey process applications for study permits, work permits, permanent residency, and refugee claims.
Meanwhile, dis investigation dey come for time wen Canada dey cut numbers of international students, foreign workers and asylum seekers wey dey enta di kontri.
Di report bin give categories of di kain misconduct wey di employees bin involve in.
- Misconduct related to security clearance
According to di IRCC investigation, one case processing agent bin ask anoda employee through dia work messaging application if dem go accept money in exchange to approve a study permit.
Di processing agent bin quickly change di story say na anoda individual wey e dey owe money bin use im laptop to request di bribe.
Dis don raise serious concerns about how vulnerable di Canada immigration system dey and becos say International students dey contribute billions to Canada economy, any tori of corruption for di study permit process fit affect plenti applicants wey dem catch.
- Breach of Values and Ethics Code or IRCC Code of Conduct
According to IRCC, dem find three employees wey breach dia code of conduct. Di case include employee wey dey speak negatively about clients from a specific kontri.
Also, di investigation find say one employee bin form a social relationship wit an asylum claimant wey e meet for IRCC Asylum Hotel. E give am preferential treatment and tell am how to engage wit di Department, and co-sign on di claimant car loan.
Dis dey against IRCC code of conduct and e cause conflict of interest- e chop suspension witout pay.
Canada say dem also dey aware of some marriage fraud wey pipo wey dey apply to enta dia kontri dey engage in.
“Immigration officers sabi how to detect false marriages, and e get serious criminal charges.”
Dem say na crime for foreign applicant to set up wetin dem know as “marriage of convenience” to allow spouse to immigrate to Canada.
IRCC say some of di disciplinary measure wey IRCC bin take against dia own employee wey dey involved for dis misconduct include written reprimands, suspensions witout pay, terminations, and security status revocations.
Canada government say dem dey committed to transparency, and dem go serve corrective measures so odas fit learn and grow from wahala of any wrongdoing.
Dem go begin training and awareness campaigns, to actively create an environment wit strong ethical standards.
Di Immigration department say dem want make dia immigration process dey safer, transparent and free from misconduct.
“Di objective of dis report is to increase confidence for our systems of accountability, becos IRCC play a key role both for Canada and internationally to facilitate di entry of temporary residents; manage di selection, settlement, and integration of newcomers; grant citizenship; and issue passports to citizens.”
Meanwhile, dis dey come afta Canada Prime Minister Mark Carney and im Liberals party say e dey important to implement policies wey go address challenges wey di kontri dey face in terms of immigration.
Although for 2024, Canada govment bin announce new immigration plan wey go reduce di number of international students and foreign workers, PM Carney say im govment dey take action to bring immigration to “sustainable levels” by 2027.
Di plan na to reduce temporary residents wey include international students, foreign workers, amongst odas as well as keep permanent resident admission for less dan 1% of Canada population.
Share on:
Recent Articles
Recent Articles

Why do university websites drive international students away?
Why do university websites drive international students away? For most international students, the university journey begins not on campus, but online. Nirma Jayawardena offers insights on how institutions can improve

Japan enacts bill to drastically raise visa-related fees
Japan enacts bill to drastically raise visa-related fees Japan enacted a bill on Friday to raise visa-related fees for foreign nationals by up to 30 times the current levels. The

New Zealand confirms November rollout of graduate work visa
New Zealand confirms November rollout of graduate work visa The new six-month visa and expanded post-study work rights for some graduate diploma holders will take effect from November 16 under

UK Visa Portal exposed thousands of applicants’ passports and selfies — then called the lawyers on us
UK Visa Portal exposed thousands of applicants’ passports and selfies — then called the lawyers on us A website called UK Visa Portal publicly exposed thousands of passports and selfie

Government withdraws right to appeal against some short stay visa refusals
Government withdraws right to appeal against some short stay visa refusals The Department of Justice says the change will allow applicants to receive a decision faster than waiting for the

Australia freezes new overseas student provider registrations
Australia freezes new overseas student provider registrations Labor’s 12-month pause on new VET and ELICOS applications comes amid rising visa refusals, slowing commencements and mounting migration pressure. Australia has frozen