Canada uncover case of bribery to approve study permit, ova 60 oda misconducts within dia immigration system

Di Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC) say dem don uncover series of misconduct cases within dia department, wey include employee wey dey solicit bribes to approve study permits for Canada.
IRCC bin release one misconduct report wey dem say go help dem achieve transparency and to put eye for di integrity of Canada immigration system.
Di report find say some employees dey breach privacy by accessing sensitive files and di act dey against di code of conduct of Canada immigration department.
According to di report, dem find 62 cases of misconduct out of 76 investigations and e include harassment and violations of IRCC Code of Conduct.
Di IRCC na department wey dey responsible for processing millions of immigration applications annually, wit ova 11,000 employees.
Also dis report wey cover from 2023 – 2024 dey affect department wey dey process applications for study permits, work permits, permanent residency, and refugee claims.
Meanwhile, dis investigation dey come for time wen Canada dey cut numbers of international students, foreign workers and asylum seekers wey dey enta di kontri.
Di report bin give categories of di kain misconduct wey di employees bin involve in.
- Misconduct related to security clearance
According to di IRCC investigation, one case processing agent bin ask anoda employee through dia work messaging application if dem go accept money in exchange to approve a study permit.
Di processing agent bin quickly change di story say na anoda individual wey e dey owe money bin use im laptop to request di bribe.
Dis don raise serious concerns about how vulnerable di Canada immigration system dey and becos say International students dey contribute billions to Canada economy, any tori of corruption for di study permit process fit affect plenti applicants wey dem catch.
- Breach of Values and Ethics Code or IRCC Code of Conduct
According to IRCC, dem find three employees wey breach dia code of conduct. Di case include employee wey dey speak negatively about clients from a specific kontri.
Also, di investigation find say one employee bin form a social relationship wit an asylum claimant wey e meet for IRCC Asylum Hotel. E give am preferential treatment and tell am how to engage wit di Department, and co-sign on di claimant car loan.
Dis dey against IRCC code of conduct and e cause conflict of interest- e chop suspension witout pay.

Canada say dem also dey aware of some marriage fraud wey pipo wey dey apply to enta dia kontri dey engage in.
“Immigration officers sabi how to detect false marriages, and e get serious criminal charges.”
Dem say na crime for foreign applicant to set up wetin dem know as “marriage of convenience” to allow spouse to immigrate to Canada.
IRCC say some of di disciplinary measure wey IRCC bin take against dia own employee wey dey involved for dis misconduct include written reprimands, suspensions witout pay, terminations, and security status revocations.
Canada government say dem dey committed to transparency, and dem go serve corrective measures so odas fit learn and grow from wahala of any wrongdoing.
Dem go begin training and awareness campaigns, to actively create an environment wit strong ethical standards.
Di Immigration department say dem want make dia immigration process dey safer, transparent and free from misconduct.
“Di objective of dis report is to increase confidence for our systems of accountability, becos IRCC play a key role both for Canada and internationally to facilitate di entry of temporary residents; manage di selection, settlement, and integration of newcomers; grant citizenship; and issue passports to citizens.”
Meanwhile, dis dey come afta Canada Prime Minister Mark Carney and im Liberals party say e dey important to implement policies wey go address challenges wey di kontri dey face in terms of immigration.
Although for 2024, Canada govment bin announce new immigration plan wey go reduce di number of international students and foreign workers, PM Carney say im govment dey take action to bring immigration to “sustainable levels” by 2027.
Di plan na to reduce temporary residents wey include international students, foreign workers, amongst odas as well as keep permanent resident admission for less dan 1% of Canada population.
Share on:
Recent Articles
Recent Articles

Glasgow Caledonian pauses recruitment to BCA-risk courses
Glasgow Caledonian pauses recruitment to BCA-risk courses Glasgow Caledonian University has halted international student recruitment to courses at risk of being non-compliant to comply with the newly proposed BCA metrics

Canada Extends PGWP to 2026: Over 1,100 Courses Now Eligible for 3-Year Work Permits
Canada Extends PGWP to 2026: Over 1,100 Courses Now Eligible for 3-Year Work Permits Canada’s Big Move: Work Permits for International Students Now Extended to Early 2026 – Over 1,100

US cuts visa validity for applicants from three African countries
US cuts visa validity for applicants from three African countries The United States has announced sweeping changes to its non-immigrant visa policy for Cameroon, Ethiopia and Nigeria, cutting the duration

Cost of Australian student visa jumps to AUD$2,000
Cost of Australian student visa jumps to AUD$2,000 Already home to the highest student visa fee in the world, the Australian government has made studying there even more expensive. The

‘Make foreign students pay £10k deposit so they don’t claim asylum’
‘Make foreign students pay £10k deposit so they don’t claim asylum’ Foreign students should be made to pay an upfront £10,000 surety to prevent them claiming asylum, a think tank

‘Don’t move money before your visa Interview’ – UK Deputy Head of Mission to Nigerians
‘Don’t move money before your visa Interview’ – UK Deputy Head of Mission to Nigerians He also cited examples of actions that could raise red flags for clearance officers and